Wednesday, August 7, 2013
AKPORS LETTER TO FIFA 2013 MAKERS:
"Bros una well done oooh, I dey gbadun una game 4 my bros game house 4 ughelli, e even get branch for sapele and warri... U know say we no dey carry last, buh d thing wey dey pain me be say when we dey play d game small errors dey dere... Shey una dey get my point abi?
Ok, make I give una example!
if i ask mikel to shoot in front of the goal post he will still pass..
If I ask messi to pass he will dribble wif dat him 1 leg
If I ask torres to score goal 4 me, him go dey use shot dey pluck mango wey dey outside pitch
Y ballotelli no get teeth for the game? Him face just black like goat shit,
Y ferguson no dey chop shin gum?
I don dey play league with arsenalsince February buh I no see trophy, even when I use wuru wuru win am dem still no gree gimme trophy,
Abeg errors full the game... If una no go change am, no try sell una CD ooh.. Cos Waffi boiz dey vex oooh.. Make una no try come uptown 4 ughelli, sapele cos we go change am 4 una...
Thank u
Na still ur boy
Akpos..........Una need full name? Waka dier"
Labels:
2013 Football,
Fifa
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment
Please kindly drop your comment(s) thank you.